African leaders wey don tay for power

Robert Mugabe

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Robert Mugabe before im resign as Zimbabwe president, na di leader wey old pass for Africa

Equatorial Guinea President Teodoro Obiang Nguema wey don dey power since August 1979, na di leader wey don tay pass for power.

Before now, di person wey follow Obiang na Zimbabwe former president Robert Mugabe, wey don rule di country since independence for April 1980 but im resign on Tuesday.

When im be president, Mugabe bin get record for di leader wey old pass for di world, im be 93 years old.

Leaders wey don dey run things tay-tay

Teodoro Obiang Nguema - Equatorial Guinea - 38 years

Equatorial Guinea President Teodoro Obiang Nguema

Wia dis foto come from, Getty Images

Im become leader on August 3, 1979, after coup wey comot im own uncle, Francisco Macias Nguema, wey dem kill for firing squad.

Paul Biya - Cameroon - 35 years

Paul Biya

Wia dis foto come from, Patrick Kovarik/AFP/Getty Images

Im become president on November 6, 1982 after e do seven years as prime minister.

Denis Sassou Nguesso - Congo - 33 years

Denis Sassou Nguesso

Wia dis foto come from, Amanda Lucidon

Im first serve as president from 1979 to 1992 and later after di civil war im come back to rule for 1997.

Yoweri Museveni - Uganda - 31 years

Yoweri Museveni

Wia dis foto come from, Foreign and Commonwealth Office

Im become Uganda leader on January 1986 after im win di war to comot Idi Amin Dada.

Omar al-Bashir - Sudan - 28 years

Omar al-Bashir

Wia dis foto come from, Mohsen Al Faki

After coup wey im lead, Al-Bashir dey rule since June 1989.

Idriss Deby - Chad - 27 years

Idriss Deby

Wia dis foto come from, Foreign and Commonwealth Office

Im don dey power for di north-central African country since December 1990.

Issayas Afewerki - Eritrea - 24 years

Issayas Afewerki

Wia dis foto come from, Freedom4E

Di head of state don dey power since 1993.