Xenophobia: President Buhari special messenger don land South Africa

Ambassador Ahmed Abubakar

Wia dis foto come from, Facebook

Wetin we call dis foto, Director-General of di National Intelligence Agency, Ahmed Abubakar

Di special messenger wey Nigeria send go South Africa to do tok-tok with President Cyril Ramaphosa don land Johannesburg.

Di Nigerian High Commissioner and oda mission officials receive di ambassador, di Director-General of di National Intelligence Agency, Ambassador Ahmed Abubakar for di O.R Tambo International Airport.

Dis wan dey come afta Presido Muhammadu Buhari bin tok say e go send special envoy go di kontri to assess di situation.

For statement wey Nigeria Ministry of Foreign Affairs release, dem tok say di High Commissioner of Nigeria to South Africa go receive di special envoy wen e arrive.

Dem add say dem go meet wit top South African officials to discuss di xenophobic attacks wey dey happun to Nigerians.

Di special messenger and di High Commissioner go come brief President Buhari on di situation and di outcome of dia meetings.

Di issue for South Africa don cause plenty kata kata for both kontris as South Africa don even close dia embassy for Nigeria and Nigeria even announce say dem no go attend di World Economic Forum wey dey happun for South Africa.

Di Nigerian mission for South Africa don confam say no Nigerian die for di attacks.