You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Dino Melaye go appeal afta tribunal comot am as senator
Read am in 1 mins
Election tribunal for Kogi state, don cancel Dino Melaye victory as senator wey dey represent Kogi west senatorial district.
For Friday judgement, di tribunal order fresh election for di district.
One of di pipo wey contest against oga Melaye, Smart Adeyemi of di APC, na im bin carri di election mata go tribunal.
Senator Melaye say no cause for alarm about di mata, say im go get judgement for Appeal court.