DJ Arafat don die for motorbike accident

Read am in 1 mins

Di Ivorian musician, DJ Arafat don die for road accident for Abidjan, capital city of Ivory Coast.

Local tori pipo RTI tok say di star wey im real name ma Houon Ange Didier, bin dey inside di car accident on Sunday night come die on Monday morning.

DJ Arafat na im be di fada of di music style wey dem dey call coupé-décalé and im biggest hit song, afro-décalé don get ova five million views for YouTube.

Di tori be say di 33 year old bin hit im motor cycle with one motor car and im fracture im skull.

For May 2019, im become di first musician for im kontri wey go reach 1 million views for YouTube in less than 24 hours for im single, Moto Moto.

African celebs like Davido don start to dey play tribute for social media.

Cameroon musician, Dencia follow add say she bin dey small wen DJ Arafat start to dey drop hits.

Nigerian musician J. Martins follow with im own tribute say DJ Arafat na king.

DJ Arafat bin don do collabo with Davido, Iyanya and J. Martins.