Tekno Agege: Nigerians hala goment tok to use di musician as 'scapegoat'

Read am in 2 mins

Nigerians for different social media platform don begin react afta news come out say art authorities refer to musician Tekno as "threat to national security" and dem go use am as scapegoat to teach odas lesson sake of im "offensive" music video shoot.

Report from plenti local newspaper say di Director General, National Council for Arts and Culture, Segun Runsewe, tok say make dem place Tekno for security agencies' watch list for dis kain behaviour.

According to di report, Oga Runsewe say di council wan make Tekno scapegoat "to teach odas a serious lesson".

"We warn say nudity no be part of our culture and we no need to tolerate am,"

"Di goment go from "henceforth fish out clubs for nude dancers across di kontri for promoters to face prosecution."

Recently, video of Tekno wit strippers inside one transparent moving van along Lekki-Ikoyi link Bridge, spread for every wia and on Thursday im release music video 'Agege' wey show scene from di viral video.

Di National Council for Arts and Culture, say dem dey disappointed say dem release di music video Agege while Teckno still dey under investigation.

Tekno bin don apologise for Instagram before police carry am for questioning afta di video of di strippers wey dey dance full everi wia for social media.

BBC Pidgin try to call di Director General, National Council for Arts and Culture, Segun Runsewe to tok on top di statement wey tori pipo say im bring out but e no pick or respond to text message.