Shiite protest: Pipo injure as Islamic Members of Nigeria clash again with police

Shiite protest
Read am in 2 mins

Members of di Islamic Movement of Nigeria (IMN) don clash again wit police for di third day of dia protest inside Abuja, Nigeria capital.

Di Shiite group wey Iran dey support also carri dia 'we no go gree' waka enta inside Lagos state on Thursday to protest sake of dia leader, Sheik Ibrahim Elzakzaky wey still dey for detention.

Dem dey demand make di authorities free am.

Report from our tori pesin for Abuja say pipo experience hold up, as motor dey try to divert dia movements, around di area wey di protest for dey happun. While pipo wey dey use leg waka, try run away go hide, sake of safety reason.

Our tori pesin also report say, di protesters bin plan to gada for Eagle Square but anti-riot policemen no gree dem to gada dia.

Dem form long line, dey march from Unity fountain area towards Eagles Square wia di federal civil service secretariat dey, wen some anti-riot police block di road to prevent dem not to move further.

Police arrest some of dia leaders and serious clash come happun, as police come dey fire teargas to drive dem. According to tori, some pipo wonjure for di protest.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Afta di violent protest wey members of di El-Zakzakky Group bin do for national assembly on di 9th of July, 2019, di Inspector General of Police, IGP M.A Adamu, come order 24 hours police surveillance for FCT and oda areas around dia.

Fire-fighters dey put out fire afta Shiite members clash with police on July 9, 2019.
Wetin we call dis foto, Fire-fighters dey put out fire afta Shiite members clash with police on July 9, 2019.

Also, di Commissioners of Police and dia supervisory Assistant Inspectors General of Police inside States wey close to FCT dey on alert to make sure say beta security dey for dia areas to avoid any palava.

Police dey waka pass motor wey burn during Shiite protest

Wia dis foto come from, Kola Sulaimon

Wetin we call dis foto, Police dey waka pass motor wey burn during Shiite protest on July 9, 2019
Picture from di scene of protest of July 9, 2019

Wia dis foto come from, Kola Sulaimon

Wetin we call dis foto, Picture from di scene of protest of July 9, 2019