President Muhammadu Buhari don re-appoint Boss Mustapha, Abba Kyari & 11 personal staff

President Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, @BashirAhmaad/Twitter

Wetin we call dis foto, President Muhammadu Buhari win election on February 23, take oath on May 29, 2019 but na dis July 2019 na im make di first cabinet appointment.
Read am in 2 mins

Four months afta e win re-election for second term, Nigeria presido don re-appoint two of im cabinet members wey bin work wit am between 2015 and 2019, come also appoint 11 new personal staff.

President Muhammadu Buhari on Friday approve di re-appointment of Boss Mustapha as Secretary to di Federal Goment of Nigeria.

Oga Buhari also appoint Malam Abba Kyari again as Chief of Staff (COS) to di President, according to Garba Shehu wey be tok-tok pesin for di Nigerian leader.

Both appointments take effect from May 29, 2019, Shehu tweet.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

President Muhammadu Buhari win election on February 23, take oath on May 29, 2019 but na dis July 2019 na im make di first cabinet appointment.

Pipo still dey wait for di list of cabinet ministers wey suppose work wit President Buhari until 2023 wen im second term go finish.

President Buhari 11 new personal staff

President Muhammadu Buhari win election on February 23, take oath on May 29, 2019 but na dis July 2019 na im make di first cabinet appointment.

Wia dis foto come from, @BashirAhmaad/Twitter

Meanwhile di Nigerian president don appoint 11 personal workers wey help am work for im office and dem include;

1. Mohammed Sarki Abba - Senior Special Assistant to di President (Household and Social Events)

2. Ya'u Shehu Darazo - Senior Special Assistant to di President (Special Duties)

3. Dr Suhayb Sanusi Rafindadi - Personal Physician to di President

4. Ambassador Lawal A. Kazaure - State Chief of Protocol

5. Sabiu Yusuf - Special Assistant (Office of di President)

6. Saley Yuguda - Special Assistant (House Keeping)

7. Ahmed Muhammed Mayo - Special Assistant (Finance & Administration)

8. Mohammed Hamisu Sani - Special Assistant (Special Duties)

9. Friday Bethel - Personal Assistant (General Duties)

10. Sunday Aghaeze - Personal Assistant (State Photographer)

11. Bayo Omoboriowo - Personal Assistant (Presidential Photographer)

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Di failure of Nigeria president to appoint im cabinet four months afta winning im second term don badly affect di kontri stock market, according to Reuters news agency.

Dem say dis cabin delay don make foreign investors to reduce dia investments and e also dey threaten di chances of growth for Nigeria economy wey be di largest for Africa.