You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Osun State Supreme Court judgement: PDP say dem no believe dia eyes, Senator Adeleke wish Govnor Oyetola well
Nigeria main opposition party say dem no believe dia eyes say di Supreme Court judgement on Friday no favour dia candidate Ademola Adeleke as e concern di September 2018 govnorship election for Osun State.
Peoples Democratic Party say di fact say di Supreme Court get divided judgement ontop dis mata, speak plenti meanings to di judgement, according to statement from di party tok-tok pesin Kola Ologbondiyan.
Meanwhile di party governorship candidate for Osun state Senator Adeleke don congratulate Govnor Adegboyega Oyetola for im victory for Supreme Court.
Adeleke for inside statement wey im tok-tok pesin Olawale Rasheed release say "I wish Governor Oyetola well in di governance of Osun State."
Tori be say Supreme Court for Abuja on Friday dismiss di appeal of Peoples Democratic Candidate and dia candidate wey challenge di election victory of Govnor Adegboyega Oyetola of di All Progressives Congress for di September 2018 vote inside Osun State, South West Nigeria.
PDP tweet say dem observe say di judgement agree say na dia candidate win, but na based on technicalities from di election petitions Tribunal na im dem cari pass di final judgement.
Di highest court for Nigeria rule say di judgement of di Osun State Election Petition Tribunal wey declare di PDP as di winner of di election no follow.
Oga Adeleke add say im ambition to be govnor of di state "no be do or die affair and im accept di ruling" of di Supreme court.
End of Di one wey oda users dey read well well