Supreme court confam Oyetola as winner of Osun election

Read am in 2 mins

Supreme Court for Abuja don dismiss di appeal of di Peoples Democratic Party govnorship candidate for di September 2018 election for Osun State, Ademola Adeleke, wey challenge di election of Govnor Adegboyega Oyetola of di All Progressives Congress.

Di highest court rule say di judgement of di Osun State Election Petition Tribunal wey declare di PDP as di winner of di election no follow.

Di court say di judge wey read di majority judgement for di tribunal, Peter Obiora, no show on February 6 2019 following di documents wey dey before di court.

Di highest court agree with di appeal court say di fact say Mr Obiora no show face wen dem hear from one key witness for di petition, affect di judgement of di trial tribunal and say di fact say Mr Obiora no show on dat day mean say di tribunal been lack di authority to judge di mata.

Justice Bode Rhodes- Vivour wey deliver di majority judgement wey five of di seven - justice of di apex court panel support say na law say wen di right panel of court no seat, di activities wey di panel do go dey invalid.

Di Acting Chief Justice of Nigeria, Justice Tabko Muhammed and three oda members agree with di lead majority judgement.

But Justice Kumai Akaas and Justice Paul Galinje tok say PDP na im win di election.

Justice Akaahs for im own minority judgement stand ground say di Independent National Electoral Commission (INEC), suppose be neutral pesin for di election.

Im say even wen INEC cancel some aspect of di 2018 Osun election, di applicant still meet di constitutional requirement of having di highest votes, but INEC come cancel di election order for re-run, dis wan show say dem bin get ulterior motive.

Meanwhile, di Presidential candidate of di PDP Atiku Abubakar don send message of encouragement give Adeleke, e post am ontop im twitter page.