You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ijegun pipeline fire: How early morning explosion kill pipo for Lagos
Two pipo don die and 31 moto burn inside di Ijegun pipeline explosion wey happun for early mor-mor on Thursday for Isheri Osun area of Lagos State, Nigeria.
Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) tok say, na pipo wey come tiff oil start di fire, as dem bin dey try to escape security operatives.
Di oga of LASEMA, Olufemi Oke-Osanyintolu say di details of how everything happun go dey more clear wen dem don face di fire finish.
Tok-tok pesin for di National Emergency Management Agency south-west, Ibrahim Farinloye, bin tell BBC Pidgin say na di pipo wey vandalize di pipeline na im dey affected for di fire.
"Di situation don dey under control. We don confam say na vandalism mata, and na only di vandals bin dey affected for di mata. "
"Out of di 12 pipo wey dey affected, 4 dey LASUTH and 8 dey Gbagada hospital."
Di fire bin make pipo for di area panic as dem wake up to see am.