Ijegun pipeline fire: How early morning explosion kill pipo for Lagos

Two pipo don die and 31 moto burn inside di Ijegun pipeline explosion wey happun for early mor-mor on Thursday for Isheri Osun area of Lagos State, Nigeria.
Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) tok say, na pipo wey come tiff oil start di fire, as dem bin dey try to escape security operatives.
Di oga of LASEMA, Olufemi Oke-Osanyintolu say di details of how everything happun go dey more clear wen dem don face di fire finish.
Tok-tok pesin for di National Emergency Management Agency south-west, Ibrahim Farinloye, bin tell BBC Pidgin say na di pipo wey vandalize di pipeline na im dey affected for di fire.
"Di situation don dey under control. We don confam say na vandalism mata, and na only di vandals bin dey affected for di mata. "
"Out of di 12 pipo wey dey affected, 4 dey LASUTH and 8 dey Gbagada hospital."
Di fire bin make pipo for di area panic as dem wake up to see am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post