Benue tanker explosion: 40 pipo die and 60 odas injure for di accident

Tanker fire explosion

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tanker fire explosion for Ibafo, Ibadan Oyo state for 2010

Authorities don confam to BBC say at least 35 pipo don die and 60 injure afta oil tanker explode for Benue state, north central Nigeria.

Police authorities tell BBC Pidgin say di incident happun at about 2pm local time on Monday wen one oil tanker fall down afta e dey try avoid a pothole for highway for Gwer-east local gofment.

Police tok-tok pesin, Sewuese Anene say from di information wey dem gada, afta di tanker fall, Ahumbe village pipo come gada to collect di fuel wey dey leak from di truck despite say police bin cut dem warning make dem no near di area.

Di total number of pipo wey wujure for di tanker explosion for Benue state don rise to 101 pipo. Di FRSC tok tok pesin, Ms Akura na im yarn BBC pidgin dis one.

She say contrary to report wey di fly upandan say plenti pipo die, na only 35 pipo die for di tanker explosion. Explain give say those wey injure dey receive treatment for eight hospitals and dem dey respond well to treatment.

Explaining how dey tin cari happun, be say tanker driver loss control afta one of im tyre burst. And in the process, some pipo for di area come di fetch di oil but as dem dey cari out dia work, na so one 18- seater bus sef dey try pass and in the process im exhaust crash ground , na so di area come catch fire.Benue state Deputy Governor, Benson Obounu don visit all those wey dey affected for di fire tanker explosion for Benue state.

Pipo wey take eye see how e happun, tell BBC pidgin say, wen di tanker fall and oil come pour for di road, di driver of one 18-seater passenger bus bin one pass, but dem warn am but e refuse to listen and na as e dey pass, explosion come happun kill all di pipo for di bus except di driver.

And as di villagers dey try quench di fire for di car, anoda big explosion come happun, pipo houses wey dey close also catch fire.

Two men from di fire service also suffer serious injury and dem dey receive treatment for hospital.

Christopher Avi bin tell tori pipo say all those wey injure don dey collect treatment for four hospital for di state.

Accidents wey involve oil tankers new tin for Nigeria.

Last August, one fuel tanker catch fire for PortHarcourt, for June at least nine pipo die for anoda major accident wey involve tanker for Lagos.