Plans to build new 450-seater Parliament chamber dey bore Ghanaians chakaa

Wia dis foto come from, Parliament of Ghana/Facebook
Plans by Ghana government to build new 450-seater Parliament chamber dey bore Ghanaians big time.
Minister for Parliamentary Affairs, Osei Kyei-Mensah-Bonsu talk sey dem no go spend more than $200 million on de new parliamentary chamber.
"We all think sey de facility no for go beyond some amount, that $200 million. We dey look at anything between $150 million den $200 million," Mr. Kyei-Mensa-Bonsu reveal.
Speaker of Parliament, Mike Ocquaye unveil de new design last Friday when de architect, David Adjaye place courtesy call on am.
But check like de move no shedda dey sit well plus some Ghanaians who start dey kick against de move.

Wia dis foto come from, Photo: Parliament of Ghana/Facebook
Africa Centre for Parliamentary Affairs (ACEPA) Executive Director, Rashid Draman say "if you consider de issues wey dey trouble de country, dis building no be priority."
Mandems con sey out of all de chaw tins wey de country dey need, hunger dey whip some people, some students dey learn under trees den stuff but leadership rather wan build new parliament chamber.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Some legislators like Kumbungu MP, Ras Mubarak say de plans for de new building be misplaced priority.
End of Di one wey oda users dey read well well
But according to Minister for Parliamentary Affairs, Osei Kyei-Mensah-Bonsu, de reason dem for get dis new chamber be sake of when dem get full house, Ministers den others who for appear on de floor no dey get place seat.
Also, de new chamber go make am possible for de President to be sworn in parliament before Parliament.











