Pawpaw meme from Nollywood dey burst pipo brain

Read am in 2 mins

Popular Nollywood actor Osita Iheme don scarce for feem as e no dey act plenti like dat but dis wan no stop as im face full every where for internet recently as pipo begin use di guy do meme.

Di actor become popular during di year 2000 wen im act for di feem 'Aki and Pawpaw'.

No be new tin say if you sabi use social media, den you go also dey use memes especially for places like Twitter.

Weda na from feem or viral video or even foto, meme dey make pipo laff.

Di latest meme wey dey bust pipo head na from di feem Stubborn Flies wey Iheme act for 2007. Di guy dey siddon for chair wit book as e come dey do like im dey calculate somtin.

And evribodi dey use am; even Rihanna beauty line - Fenty, use di meme.

Make we look as some pipo don use am.

Lyrical confusion

Life mata

No forget to make budget wen you go market

How much you don spend?

You no get mouth