BET Awards 2019: Burna Boy win Best International Act

Burna Boy perform for 2019 Coachella Festival

Wia dis foto come from, Kevin Winter/Getty Images

Wetin we call dis foto, Burna Boy perform for 2019 Coachella Festival
Read am in 1 mins

Nigerian singer Burna Boy don carri di ogbonge 'Best International Act' award for di 2019 BET Awards wey happun for America.

Dem nominate di singer along wit oda top musicians from around di world like Mr Eazi, AKA from South Africa and Giggs from di UK.

Burna Boy mama Bose Ogulu, wey also be im manager accept di award on im behalf. For her speech she tok say Burna Boy want make every black pesin know sey dem be Africans first before dem be anything.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Burna Boy for di 2019 BET Awards

Wia dis foto come from, Aaron J. Thornton/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Burna Boy for di 2019 BET Awards

Burna Boy wey announce di return of im Africa Giant tour for America, say im win di award for Africa.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Di BET Awards also give late rapper Nipsey Hussle Humanitarian Award for di work wey im do to help pipo wey dey gang before im die. Cardi B collect di album of di year prize, Tyler Perry carri Ultimate Icon Award and Rihanna present wit di Lifetime Achievement Award.