Port Harcourt Mall explosion land five pipo for hospital, police rule out terror attack

- Author, Karina Igonikon
- Role, BBC News Pidgin, Port Harcourt
- Read am in 3 mins
Three pesins dey receive treatment for Rivers State University Teaching Hospital after gas explosion happun on Wednesday for di Bakery area inside Port Harcourt Mall.
Di mall close down afta di explosion.
Head of Department for Accident and Emergency RSUTH Dr Lawson Ndu confam to BBC Pidgin say five pipo na im dem bin come di hospital afta di gas explode for di kitchen side of Port Harcourt Mall and na around 4-5pm dem bring dem come.
Di Chief Security Officer for Port Harcourt Mall na im bring dem come according to tori.
Although nobodi sabi how e happun, Nnamdi Omoni of Rivers State Police Command wey confam di explosion give BBC say dem don begin to investigate di cause.
Port Harcourt Mall tanda for old GRA side and e dey one or two minutes away from Rivers State Goment House main gate for old Port Harcourt township.

Wia dis foto come from, BBC
Port Harcourt Mall open for business hours afta explosion
Business return as shops open for Port Harcourt Mall Thursday morning after di explosion wey happen on Wednesday evening.
Wen BBC Pidgin visit di Mall, some police pipo bin dey for di area wey e happen dey do some assessment work.
End of Di one wey oda users dey read well well
Manager of di Mall, Chioma Okorie say di explosion happun for di corridor wia di kitchen of one Chinese restaurant (Spice Route) wey dey near one children clothes (Ruff n Tumble) Store and five pipo get injury wey dem carry go Rivers State University Teaching Hospital.
As at Thursday morning she say dem don transfer di patients dem go University of Port Harcourt Teaching Hospital UPTH to continue di treatment.

Wia dis foto come from, PORT HARCOURT MALL
She come add say di explosion no serious as some bin dey tink as na dem handle am with di system wey dey ground and dem dey cooperate with di Police investigation wey dey go on.
"As for wetin cause di explosion we still dey find out as na di pipo wey injure na im fit tell us but for di state dem bin dey yesterday for di hospital, we no fit ask dem question as dem him dey for oxygen mask. Dis morning dem don transfer dem go University of Port Harcourt Teaching Hospital and so far nobody don die." Na so she tok.
Some pipo wey bin dey di PH Mall wen di incident happen don tok how e happen for dia social media pages.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post

Wia dis foto come from, Chioma Ezenwafor
Rivers State Goment officials wey di Secretary to di Goment , Dr Tammy Danagogo bin go see how tins happen come say dem go meet with Management of di Mall to discuss oda aspects of di incident and wia di State Goment fit intervene.
Police also release statement say di tin wey happun no get anytin to do wit terror attack.
But one local tori pesin for Port Harcourt post dis tweet on Thursday Morning:
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Until authorities give update so far di victims of di explosion dey recieve treatment for hospital while officials of di Mall and di Rivers State goment together wit police dey continue investigation ontop di mata.












