You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria goment go give 10% discount if your ship land for Delta, Rivers and Calabar ports
Read am in 1 mins
Nigeria Ports Authority don approve 10% discount for ship wey land for Delta, Rivers and Calabar ports.
Di discount wey go take effect immediately, na to encourage business pipo to use those ports more, di official statement bin tok.
No be every vessel go fit take advantage of di ten percent discount. Those wey qualify na:
- Container vessels wit at least 250 TEUs
- General cargo vessels wit at least 16,000 MT
- Combo vessels wit at least 16,000 MT
- RORO vessels with at least 250 units of vehicles
And di ones wey no fit claim di discount na:
- Vessels coming INBALLAST
- Vessels calling at private jetties.
- Vessels calling carrying liquid bulk.
Wetin una feel about dis new plan by di federal goment? Abeg follow use di form under to share your comment wit us.