You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Police rescue two Canadian girls wey dem kidnap for Ghana
Police sey dem rescue de two Canadian ladies wey dem kidnap for Kumasi last week Tuesday.
Dem find de two Wednesday morning.
Dem rescue di girls after combined efforts from Ghana den Canadian authorities.
Information Minister, Kojo Oppong Nkrumah sign de statement wey en Ministry release.
De unknown gunmen according to reports abduct de girls gunpoint, wey dem force dem inside some vehicle around 8.20pm after dem left dema apartment.