You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Okorocha: Court order INEC to give di former govnor im certificate of return as Senator
Federal High Court for Nigeria capital Abuja don order di Independent National Electoral Commission (INEC) to give former Imo state govnor Rochas Okorocha im Certificate of Return for di National Assembly election wey happun for February 23 2019.
Justice Okon Abang give di order afta im judge di mata wey Okorocha make against INEC say dem hold im certificate of return afta dem declare am winner of di Imo West Senatorial District.
INEC bin no wan give am di certificate unto say di Returning Officer wey dey in Charge of di election say, im declare Okorocha winner under duress.
But judge say INEC decision dey against di law becos, "once dem don declare under section 68© of di Electoral Act, INEC no get any authority at all to hold di certificate of return.
Okorocha tok-tok pesin Jones Onwuasoanya say di wahala na sake of some "anti democratic elements" wey bin dey plan "dangerous conspiracies."
Although INEC for im reply to di judgement say dem go meet as soon as possible to do di needful, dem also criticise di order say dia fear na about di safety of dia staff.
Dem worry say if di law no punish electoral malpractice, anybody go fit threaten dia officer to declare in dia favour and still get dia certificate of return.