Kayode Fayemi: How Ekiti State Govnor win Chairman election for Nigeria Govnors Forum

Wia dis foto come from, Twitter
Di govnor of Ekiti State Kayode Fayemi na di new Chairman of di Nigeria Govnors Forum.
Tori be say na late night on Wednesday oga Fayemi become chairman of di Govnors Forum during one meeting for Abuja.
Di Govnor wey be Nigeria former Minister of Mines and Still until July 2018, win about 70 percent of di votes to win di Chairmanship of di Govnors Forum.
Na Kaduna State Govnor Nasir El-Rufai, and Delta State Govnor, Ifeanyi Okowa nominate Fayemi for di election.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Sokoto State Govnor Aminu Tambuwal go act as Fayemi deputy inside di forum.
Govnor Kayode Fayemi go succeed di Zamfara State Govnor Abdul-aziz Yari Abubakar we tenure end last night.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Wetin you suppose know about oga Kayode Fayemi?
Kayode John Fayemi come from Isan-Ekiti for Oye local goment area of Ekiti state. Dem born am on February 9, 1965.
Fayemi don lecturer work for different parts of di world including Africa, Europe, America and Asia.
End of Di one wey oda users dey read well well
Im bin be govnor of Ekiti state for 2010 under Action Congress of Nigeria.
Before before, im bin work as journalist, researcher, im also be writer and development adviser.
Im get im first degree from University of Lagos, im second degree from University of Ife and im PhD from Kings College University of London.
Im dey married to Olabisi Fayemi.










