Fayose: Five tins wey Nigerians go miss about di former Ekiti govnor

Wia dis foto come from, @GovAyoFayose
EFCC, I dey here! Na wetin former Ekiti govnor, Ayodele Fayose, write for im shirt as e land for di office of Nigeria anti-corruption agency.
Mr Fayose don finish im term as govnor of di southwestern state and Dr Kayode Fayemi don do swearing-in on Tuesday 16 October.
Di former govnor dey popular for Nigeria sake of di plenti drama wey e dey act.
If im no climb okada today, im go attack President Muhammadu Buhari tomorrow.
Di latest drama now na di kwanta wey im dey face wit di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 1
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 2
But as Mr Fayose no dey run tins again and immunity wey im get don expire like two-day old gala, e possible say Nigerians no go dey see di drama wey di former govnor dey sama kontri pipo again?
Dis na five tins wey pipo go miss about Ayo Fayose.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Buka parole don finish?
Before, e possible say you fit dey your favourite buka dey wait as dem dey arrange your normal Amala and draw soup, and oga Fayose go just appear for your side dey arrange im own.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3
Or, you dey market to buy kpomo and you just see say you dey follow drag price wit anoda customer - Mr Fayose!
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4
All dat one still dey possible or e don end?
Hello...hoga govnor...hi haff complain
Evribodi know say to meet or tok to govnor for Nigeria be like pesin wey dey target Jamb cut-off mark.
But for Ekiti pipo, e sure die say dem go miss how dem fit just carri phone, call dia govnor anytime.

Wia dis foto come from, TWITTER/@OFFICIALPDPNIG
Road closed! For political reason
Oga Fayose na pesin wey no dey waist time to enta one trouser wit anybodi wey wan try am. And e no dey mind di kain trouser sef - weda na jeans, lace or corduroy.
Nigerians go remember how all di road wey enta Ekiti state dey nack padlock anytime wey political kwanta land wit opposition party or wit state house of assembly members.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 5
Okada rider
One of di pipo wey go miss di former govnor pass na okada pipo. Dem go miss how dem bin dey follow Mr Fayose convoy.

Wia dis foto come from, Getty Images
Buhari Bumper-to-bumper
E possible say na Mr Fayose dey yab President Buhari pass among opposition pipo.
Di former govnor no dey hide mouth or face anytime wey im feel say oga presido way no pure.
Nigerians no go forget how Mr Fayose trace Mr Buhari go abroad just to yab am sake of say im dey go borrow money.