Fayose don land EFCC domot to face im warrant

Wike and Fani-Kayode wey escort Fayose warn di EFCC make dem no maltreat di former Govnor.

Wia dis foto come from, Lere Olayinka

Wetin we call dis foto, Wike and Fani-Kayode wey escort Fayose warn di EFCC make dem no maltreat di former Govnor.
Read am in 1 mins

Ayodele Fayose, di former Govnor of Ekiti state finally show face for Economic and Financial Crimes Commission office inside Abuja on Tuesday afternoon to submit imsef to Nigeria corruption police.

Rivers state Govnor Nyesom Wike and former Minister of Aviation Femi Fani-Kayode follow Fayose enta di EFCC office for Wuse 2 area of Abuja, wia im go face im warrant.

Skip Facebook post, 1

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 1

Ayodele Fayose

Wia dis foto come from, Lere Olayinka

Wetin we call dis foto, Ayodele Fayose

Fayose wey dress like school boy, wear T-shirt wey dem customize "EFCC I'm Here" wit jeans and face cap.

Skip Facebook post, 2

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 2

Fayose tell tori pipo wey dey di EFCC office say di commission send dia men come im house, upon say im don alredi gree to submit imsef to dem.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Wike and Fani-Kayode warn di commission make dem no maltreat Fayose.