Ekiti election: EFCC delete 'parri is over...' tweet wey concern 1.3bn magomago for Ekiti

Fayoṣe

Wia dis foto come from, @fayose

Wetin we call dis foto, For 2005, EFCC file case against Ayodele Fayose as dem claim say im kolobi 1.3 billion naira for poultry project.
Read am in 2 mins

Nigeria corruption police Economic and Financial Crimes Commission, EFCC delete tweet dem bin post on Sunday afternoon say dem don "dust files" wey dey dia hand concerning mago mago. Na wetin BBC Pidgin notice on Monday.

EFCC tweet di 'parri is over...' Sunday afternoon wey make nay pipo begin tok say dem wan begin investigate Ayo Fayose, wey be di govnor of Ekiti State for southwest Nigeria.

For 2005, EFCC file case against Fayose as dem claim say im kolobi 1.3 billion naira for poultry project.

Di kontri corruption police say Fayose use Biological Concepts Limited, company wey Gbenga James - Fayose friend own to defraud Ekiti State of 1.3 billion naira.

Tori be say immediately afta INEC declare result say Fayose party PDP lose di 14 July Ekiti governorship election, EFCC wey dey investigate mata wey concern magomago on top goment moni post di tweet.

Pipo read am as message to Ayo Fayose, wey be di govnor of Ekiti State for southwest Nigeria say e go fit soon find imself for court.

Wia dis foto come from, TWITTER/@EFCCOFFICIAL

Pipo read am as message to Ayo Fayose, wey be di govnor of Ekiti State for southwest Nigeria say e go fit soon find imself for court.

Di time wen EFCC post di tweet BBC tori pesin wey dey ground for Ekiti dey monitor tins try to reach out to oga Fayose for Government House Ado-Ekiti and even for im Irẹpodun/ifẹlodun - im local goment area but e no dey dia.

As dis one dey happen Presido Muhammadu Buhari Special Adviser Lauretta Onochie post one flight ticket to Paris on top twitter wey get govenor Fayose name inside.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Fayose na im still be govrnor of Ekiti state, but im tenure dey expire for October 2018 wen govnor-elect Kayode Fayemi go take over.

Fayose

Wia dis foto come from, @GovAyoFayose

Wetin we call dis foto, Govnor Ayo Fayose na pesin wey sabi give President Buhari bad mouth and many pipo dey feel say na im EFCC dey tok about

Nigerian constitution give immunity to some pipo wey include govnor and dia deputy, wey mean say dem no go fit cari dem go court wen dem dey for office.

E neva tey, wey EFCC win court case against two former govrnors of Taraba and Plateau States for magomago wey dem do while dem dey for office.