Trump, Buhari, Kenyatta, oda world leaders condemn Sri Lanka attacks

Wia dis foto come from, AFP
Leaders of kontris around di world don condemn di Easter Sunday attacks for Sri Lanka wey don take hundreds of lives and wunjure as many pipo.
United States of America President Donald Trump yan say im kontri dey offer condolence to pipo of Sri Lanka afta di April 21 attacks wey don kill more than 207 pipo and put over 450 for hospital.
For message wey im release for Twitter, Trump say dem ready to assist di Asian kontri.
French Presido Emmanuel Macron also condemn wetin di attackers do for Sri Lanka and say "France go stand with di kontri at dis time of need".
Nigerian Presido Muhammadu Buhari too "express shock and sadness over di attacks", say Nigeria understand wetin Sri Lanka dey go through since di kontri also get terrorism palava.
Oda world leaders wey chook mouth to condemn wetin happun include British Prime Minister Theresa May, German Chancellor Angela Merkel and Kenya Presido Uhuru Kenyatta.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Oga Kenyatta, for message im send to Sri Lanka Presido Maithripala Sirisena, pledge im support.
"We sef face mindless terrorist massacres for own kontri and we stand wit our Sri Lankan brothers and sisters for prayer during dis difficult period.
End of Di one wey oda users dey read well well

On 15 January, 2019, Kenya suffer one of di worst terrorist attack for di capital Nairobi wen 20 pipo die for di hand of gunmen. Di memory of di incident go still fresh for pipo mind.
Sri Lanka goment don block social media sites and also put 6pm to 6am curfew for di city of Colombo to help bring di situation under control and e never dey clear when dem go lift di curfew.













