Kenya attack: Wetin you suppose know about gbege for DusitD2 hotel, Nairobi

Wia dis foto come from, Reuters
United States goment on Thursday deny tok tok wey dey go around on social media say dem know about di January 15 DusitD2 Hotel terrorist attack before e happun.
Di official statement wey dem date 17 January, 2019 come from di US Ambassador to Kenya, Robert F. Godec, wia im warn against fake news and how e fit block di work wey dem dey do to defeat terrorism.
Di US also reject rumour say because of wetin dem know, American citizens wey dey Kenya don get advance warning from dem not to near di DusitD2 hotel to avoid gbege.
Di attack wey be di first terror attack for Kenya since 2015, take di life of at least one American, businessman Jason Spindler.
Wetin we know so far
Somalia-based Islamist group al-Shabab say na dem dey behind di attack.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Di day afta di attack Kenya President Uhuru Kenyatta comot to address im kontri pipo and assure dem all those wey involve for di attack don die and im goment no go stop to find and deal wit all those wey involve for di attack.
On Thursday 17 January, authorities for Kenya say dem don arrest nine people wey dem suspect say get hand for di attack.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
So far na at least 21 people di attack kill, according to authorities.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na 19-hours na im di gbege cari happun inside DusitD2 hotel and business complex on Tuesday.
Five attackers na im carry out di attack and dem don kill all od dem according to President Uhuru Kenyatta.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3















