How NYSC corpers fit get di free laptops and phones wey EU wan dash dem

Read am in 1 mins

Di European Union don announce plan to dash dia equipment to NYSC members wey work during di 2019 general elections for Nigeria.

Dis equipment - like mobile phones, laptop computers and printers - na di ones wey di EU demsef use for dia election monitoring work and now dem wan take am appreciate corpers wey do temporary work (ad-hoc staff) or do voter education work for for dia "contribution and sacrifice".

Any NYSC member wey dey interested need to send in entry ontop social media: Instagram and Twitter.

How to enter

Dis na wetin EU dey ask from corpers wey wan collect dis awoof equipment

  • Upload photo of yoursef wey show you dey do di ad-hoc staff work or voter education work
  • Also add video wey no pass 30 secs wia you go say why you choose to volunteer
  • Send dis material as message to dem ontop Twitter or Instagram on @EUinNigeria
  • Tag am wit #EU4DemocracyNG

EU say di deadline na 3 April, 2019 and dem go from dia choose who deserve to win.