How NYSC corpers fit get di free laptops and phones wey EU wan dash dem

Wia dis foto come from, Getty Images
Di European Union don announce plan to dash dia equipment to NYSC members wey work during di 2019 general elections for Nigeria.
Dis equipment - like mobile phones, laptop computers and printers - na di ones wey di EU demsef use for dia election monitoring work and now dem wan take am appreciate corpers wey do temporary work (ad-hoc staff) or do voter education work for for dia "contribution and sacrifice".
Any NYSC member wey dey interested need to send in entry ontop social media: Instagram and Twitter.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
How to enter
Dis na wetin EU dey ask from corpers wey wan collect dis awoof equipment
- Upload photo of yoursef wey show you dey do di ad-hoc staff work or voter education work
- Also add video wey no pass 30 secs wia you go say why you choose to volunteer
- Send dis material as message to dem ontop Twitter or Instagram on @EUinNigeria
- Tag am wit #EU4DemocracyNG
EU say di deadline na 3 April, 2019 and dem go from dia choose who deserve to win.









