Google Station awuf internet 'no dey finish' - Juliet Ehimuan-Chiazor, Google Nigeria Director
Google Station na latest fast speed and free internet awuf from internet search company Google or pipo wey tanda for parts of Lagos, bizness capital of Nigeria.
"You fit use am watch anytin" di awuf internet "no dey finish' in fact more places dey come inside Google Station " Juliet Ehimuan-Chiazor wey be Google Nigeria Director tell BBC Pidgin on Thursday.
Ehimuan-Chiazor say di plan na to make sure say more Nigerians participate for digital economy.
Nigeria Vice Presido Yemi Osinbajo dey hope make correct internet dey inside market
How you go fit use dis new ogbonge awuf WiFi internet for Nigeria
Internet search company Google on Thursday launch Google Station wey be dia fast speed internet station for Lagos, Nigeria.
Wetin go dey sweet pipo belle na say e no go cost anytin to use dis internet, because na free!
For event inside Lagos, Google announce dia partnership with Nigeria to bring free and fast internet to di masses.
Places wey Google Station free internet dey now

- The Palms shopping mall, Lekki
- Landmark events centre, Victoria Island
- University of Lagos, Akoka
- MMA2 (Domestic Airport)
- Ikeja City Mall, Alausa, Ikeja
- Computer Village, Ikeja
Google Station wey don launch for Lagos go allow Nigerians to enjoy internet wey dey 'fast, reliable and no go drop', all dey need na to dey any of di six locations wey Google Stations wey dey di city.
Nigeria no be di first kontri wia Google don do dis kain tin for - India, Mexico, Thailand and Indonesia don dey enjoy am already.
End of Di one wey oda users dey read well well
Google Kontri Director for Nigeria, Juliet Ehimuan-Chiazor, say di plan na to make sure say more Nigerians participate for digital economy.
Google say anyone wey wan use dia free internet no need to worri about mago-mago pipo wey wan tiff dia personal information because di way dem don do am, e no fit happun.
By di end of 2019, Google go carri dis free internet service reach 200 locations for five Nigerian cities join Lagos — Port Harcourt, Abuja, Kaduna, Enugu and Ibadan
UK company Cable wey dey test an rank broadband internet all over di world say di speed of di Google Station go reach 30 megabits per second (Mbps). Meanwhile di average internet speed wey bin dey Nigeria na 1.86 Mbps.
















