Adamawa supplementary election: INEC don announce Thursday as new date

Wia dis foto come from, INEC
Independent National Electoral Commision (INEC) don fix Thursday March 28, 2019 as di new date wey dem go conduct supplementary governorship election for Adamawa state, north east Nigeria.
Dis decision dey come afta high court for Adamawa state on Tuesday morning remove order wey bin block road for INEC to do extra election for 44 polling units dem for di state.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Na Movement for Restoration and Defence of Democracy (MRRD) bin file case for court against INEC to stop di supplementary election for Adamawa.
Afta di 9 March Govnorship election, INEC declare di election inconclusive.
As at wen di election enta inconclusive, di Peoples Democratic Party candidate, Hammadu Fintiri bin dey lead wit 32,476-votes from di first election afta gada 367,471 votes while di candidate of All Progressives Congress, Jubrilla Bindow get 334,995 votes.








