Osun election tribunal: PDP Ademola Adeleke say im dey ready to jam APC for appeal court

Wia dis foto come from, PDP
Senator Ademola Adeleke, di PDP candidate wey win Friday judgement of Osun State Govnorship Election Tribunal say im dey ready to jam Govnor Gboyega Oyetola for Appeal Court if im carry di matter go dia.
Already Nigeria ruling All Progressives Congress APC and dia party candidate Gboyega Oyetola say dem go file motion of appeal against di tribunal judgement wey declare PDP Ademola Adeleke winner of di September 2018 govnorship election inside di state.
Di court judgement land dis afternoon, but by law, di tribunal na first court, di mata go still go appeal and supreme court before di end of di case.
Senator Adeleke tell local tori pipo Channels TV say im dey hope say Nigeria election office - Independent National Electoral Commission go obey di judgement of Osun Election Petition Tribunal wey pass judgement on di 2018 govnorship election.

Wia dis foto come from, @Gboyega Oyetola
On Friday di three-man panel of Judges wey sit for Abuja tok say di All Progressives Congress and dia candidate, Gboyega Oyetola wey INEC declare winner no suppose win because, according to dem Govnor Oyetola no dey validly returned.
Di tribunal also order INEC to withdraw di certificate of return wey dem give oga Oyetola and present fresh one to Senator Adeleke.
But Govnor Oyetola don tok say im go appeal di Judgement for Appeal Court.

Wia dis foto come from, Twitter/@IsiakaAdeleke1
Di tribunal say di All Progressives Congress and dia andidate, Gboyega Oyetola wey INEC declare winner no suppose win because, according to dem Govnor Oyetola no dey validly returned.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di three-man panel way pass di ruling inside Abuja Friday afternoon say di rerun election wey happun on September 27 dey illegal.
Di tribunal say oga Adeleke na im win di election wen di first vote on 22 September happun, and di rerun election wey INEC do to reach di final conclusion one week later on 27 September dey illegal.
Davido say light don come
Dis na how David Adeleke wey be di nephew of di PDP candidate take react for twitter.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3
Atiku say Judiciary na last hope
Afta di tori land, Atiku Abubakar, di PDP Presidential candidate for di 2019 general election wey him sef get case against APC Muhammadu Buhari for election tribunal, tweet say di judiciary na last hope for common man
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4
Ayo Fayose belle dey also sweet am
Former Ekiti state Govnor Ayo Fayose belle dey also sweet am, na so im tweet im mind as di outcome of di judgement land.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 5
Dis na how pipo dey celebrate di court judgement for Ede Osun state
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 1
Senator Adeleke dey popular as di dancing Senator
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 2
We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.