Air Travel: Five sharp tips for aeroplane travel

Air Travel

Wia dis foto come from, Other

Read am in 2 mins

No listen to anybodi wey no wey no wear uniform, if want information go ask for helep desk, dat na some of di sharp informate you suppose know if you be pesin wey dey travel wit aeroplane or pesin wey neva travel wit am before.

If you, your friend or family member na di kain wey dey like to travel by air, dis na some very important tins wey di you suppose sabi.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Na Managing Director of Federal Airport Authority of Nigeria Saleh Dunoma share dis on Wednesday.

Travel Tip 1

  • If you dey travel, make sure you leave your house two hours before di time. Dis one go helep you make sure say you avoid traffic wey you no plan for. You go also fit finish all di process before wey you suppose complete inside airport.

Travel Tip 2

  • When you reach airport, make sure you park for di area wey dem say make you park so airport security no go sama you fine.

Travel Tip 3

  • As you enta di airport terminal building, try dey look di signboards wey dey give direction. Signs dey evriwia inside di building to direct you to wia you suppose go.
PH Airport

Wia dis foto come from, FAAN

Wetin we call dis foto, Nigerian goment don dey try to upgrade and improve kontri airport dem - dis one na di new Port Harcourt airport

Travel Tip 4

  • Inside airport, no listen to anybodi wey no wear uniform. If you get question go information desk, dia dem go tell you wetin you suppose know.

Travel Tip 5

  • Make you listen well well to announcement and follow evritin wey di announcer dey tok so you no go miss your flight.
Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2