Rivers Govnorship Election Result: Na 'fake news' say court order INEC to stop collation of results

INEC Chairman Mahmud Yakubu

Wia dis foto come from, INEC Situation room

Nigeria join bodi ontop election mata di Independent Electoral Commission don deny tori wey dey fly upandan say court order dem to stop di collation of of di March 9 govnorship and state house of assembly election results for Rivers state.

Tori bin dey fly upandan say court grant interlocutory injunction wey favour di African Action Congress (AAC) to stop di Independent National Election Commission from continuing wit di collation of results for Rivers state.

Di tori also say Labour Party, and di Advance Peoples Democratic Alliance (APDA) also file separate applications against INEC for di federal high court for Abuja ontop di process.

But di tok-tok pesin of INEC Rotimi Oyekanmi tell BBC say na fake news.

"No no no no e no true, na rumour, na fake news, nothing from any court from Rivers as I dey speak.

"We suppose release di guidelines today, e go happun before di close of work today." Na so Oyekanmi tok.

INEC don already press pause ontop counting and declaration of di govnorship result for Bauchi state afta court order wey stop dem .

INEC bin suspend di collation of di govnorship results for Rivers state afta katakata burst.