Bauchi election results 2019: INEC don obey court to stop declaration of Bauchi Govnorship Election winner

INEC don obey court to stop Bauchi Govnorship result

Nigeria election office don comply wit court order to stop counting and declaration of result wey concern Bauchi governorship election for north-western part of di kontri.

Justice Inyang Ekwo of Federal High Court, Abuja issue order to stop di Independent National Electoral Commission (INEC) from proceeding wit di collation, conclusion and announcement of di result of 9 March, 2019 governorship election for Bauchi.

Na on Tuesday high court wey dey sit for Abuja pass judgement for di Bauchi mata as dem dey prepare to continue collation for Tafawa Balewa local goment according to Daily Trust Newspaper.

Di court wey land ontop one ex parte application wey All Progressives Congress and di current govnor of Bauchi State, Mohammed Abubakar file.

But INEC go go ahead with collation for State House of Assembly elections wey happun for di north-western state.

Daily Trust reporter John Chuks wey attend di hearing tok say Justice Ekwo Ejembi give di ruling after Bauchi State Governor Mohammed Abubakar sue INEC as to why dem go continue with di collation.

Mohammed Abubakar

Wia dis foto come from, Bauchi State

Wetin we call dis foto, Mohammed Abubakar

Di oga di law say di order go last till di determination of di case wey two odas cari come court.

Tori be say na on Tuesday morning INEC dey ready to continue collation and after dem don set to start na im court order come say make dem stop.

Na on Saturday INEC announce say dem make mistake for di collation of Ningi wia issues bin dey four polling units wey get 2533 instead of 2533.

INEC

Wia dis foto come from, Situation Room

Bauchi dey among six states wey INEC bin declare governorship elections as inconclusive.

Tori be say INEC bin first declare di election inconclusive, but later change mind say dem go go ahead to announce di results wey dey dia hand.