Kano Governorship Election 2019: Elections dey INCONCLUSIVE!

Kano State, Elections
Wetin we call dis foto, Kano Govnorship Elections dey INCONCLUSIVE!
Read am in 5 mins

22: 07pm (Updates); INEC Chief Returning Officer Professor BB Shehu just declare di 9 March Govnorship Election for Kano State Inconclusive.

Before dem declare di results inconclusive PDP bin dey lead wit 1,020,465votes while APCdey behind wit 987,459 votes afta dem count votes from all di 44 local goment areas inside di state.

Kano don join Benue, Sokoto, Adamawa, Bauchi and Plateau states wey Nigeria election office declare say di election neva complete.

INCONCLUSIVE! mata dey happun wen di difference between di winning party and di party wey dey behind no big pass di di total number of voters for places wia election no hold. Wen dis kain tin happun di election office go need conduct fresh election for those places to decide di winner.

Before Professor Shehu finally say di election dey inconclusive e get one Local Goment Area wey give headache - Dan na Nasarawa, LGA.

INEC pipo bin try do all necessary corrections for hours before dem announce Nasarawa wey be di last wey remain for governorship elections results.

Kano State, Elections
Wetin we call dis foto, Deputy Governor of Kano State Yusuf Gawuna don regain freedom.

13:41pm (Updates):Kano police say dem no arrest Deputy Govrnor, say dem just dey wit am

Kano Police tok-tok pesin tok inside statement say Gawuna was no dey part of di team wey go to scata disrupt collation process inside Nasarawa local goment but say dem rescue am from wia di gbege happun.

Kano State Elections
Wetin we call dis foto, Kano police say dem no arrest Deputy Govrnor, say dem just dey wit am

Tori bin come out earlier say police arrest Govnor Ganduje deputy Yusuf Gawuna, afta im go scata one collation centre, but police say no be so. Police tok-tok pesin say no be arrest, say oga Gawuma just dey wit dem.

Meanwhile di state Police Commissioner Muhammad Wakil don do meeting wit di state INEC oga for di election bodi headquarters, wia dem wan begin announce more election result for di govnorship election.

March 11 10:00am (Updates): Kano police say dem no arrest Deputy Govrnor, say dem just dey wit amINEC say dem go resume Kano governorship collation as pipo dey panic

INEC for Kano State say dem dey do meeting and dem go resume to finish di last local goment wey remain to conclude counting for govnorship election wey happun on Saturday.

Na around 2am reports say police gbab di deputy governor Yusuf Gawuna and Commisioner of local goment Sule Garo as dem dey try causa wahala for Nasarawa collation centre.

Dem still dey with police as at dis time of writing dis tori and tok tok pesin for Kano Police, DSP Abdullahi Haruna yan say dem go release statement before 10am on di arrests.

For di city, pipo just dey panic as schools and banks no gree open for fear of wetin fit happun.

Kano State Elections
Wetin we call dis foto, Kano police say dem no arrest Deputy Govrnor, say dem just dey wit am

One Kano resident Sani Abu tok say na house e go dey today because e no know wetin go happun outside considering di tension wey hold everybodi.

Police go round city on Sunday night to pursue crowd wey don dey gada for different corner dey shout different political slogans.

Kano State Elections
Wetin we call dis foto, Who dey win Kano Govnorship Election?

21:30pm (Updates) Kano governorship elections for north-western Nigeria na one of di toughest sake of di struggle na between two men wey strong well well.

Former Kano Governor Rabiu Kwankwaso founder of Kwankwasiya get loyal supporters wey ready to do anything for am while Governor Abdullahi Ganduje wey don do four years in power don use di opportunity comot from Kwankwaso (im former boss) shadow form im own loyal followers wey dem dey call Gandujiyya.

So in essence pipo dey wait to see who go come out on top between Kwankwasiya and Gandujiyya members.

For Kwankwaso wey be like Nigeria main opposition PDP leader inside Kano, di stakes dey higher because e no dey go back Senate so if im in-law wey hold di Peoples Democratic Party ticket to be Governor, Abba Yusuf no win, e fit affect Kwankwaso political career

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Kano, Election
Wetin we call dis foto, Kano Govnorship Election results collation update

21:08 (Updates): Kano Govnorship Election results collation update

INEC tok-tok pesin for Kano State north central Nigeria Garba Lawal tell BBC News Pidgin say collation of results for Saturday Govnorship Election go start by 9am on Sunday.

Meanwhile Kano Police say make any party neva dey celebrate as INEC neva announce anybody or party as winner.

Di police say dem dey try avoid wetin go cause bkasala for Kano na why dem say make everybodi hold im celebrations until INEC finish dia work and announce winner.

Kano, Election
Wetin we call dis foto, Police arrest van wit ballot papers for Kano

19:15pm (Update): Kano Police confam say dem arrest van loaded with ballot papers inside Kano.

Tok tok pesin DSP Haruna Abdullahi tell BBC Pidgin say dem arrest di car for Magwan Area dis afternoon and di car dey CID wey investigations don dey follow.

17:10pm (Update): Vote counting don start for Kano Governorship/State House of Assembly election

Kano, election
Wetin we call dis foto, Kano Governorship election: Vote counting don start
list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec

list

Wia dis foto come from, Inec