Lagos Governorship Election 2019: Agbaje just congratulate Sanwoolu for phone before INEC declare am winner

Wia dis foto come from, Instagram/ @ademolaniran
19:42pm (Updates) Oga Babajide Olusola Sanwo-Olu don carry di Lagos State govnorship Elections as im party APC maintain dia grip on Nigeria commercial center, like dem dey do come since 1999.
Di INEC returning officer for Lagos Prof. Temitope Ogunmodede declare Sanwo-Olu winner afta di ruling APC party cari total of 739, 445 votes to beat main opposition PDP candidate Jimi Agbaje wey get 206,141 votes.
Di representative for APC and PDP don already carry ink sign ontop di result sheet, to say "I agree".

Wia dis foto come from, Akinwunmi Ambode

Wia dis foto come from, Sanwo-Olu
18:43pm (Updates): Lagos Govnorship Election update: Drama for INEC collation centre

Drama for INEC collation centre as one representative of di party raise objection before dem call results of di last LGA, to say di election no suppose hold.
Di man para for almost 6 minutes wey for one point security nearly carry am comot di center.
Di man objection be say electoral act say na until all materials complete for ground, di elections fit start proper but as CBN bin don comot to say dem never release materials finish, why INEC come start di elections.

17: 00pm (Updates): Result for Nigeria Lagos Election 2019

10:00am (updates): Lagos election result: Tinubu dey sure of APC win
Election bodi Independent National Electoral Commission don begin announce results for different state wia govnorship election happun.
Nigeria commercial capital Lagos na one state wey pipo out eye for dia result wella.
End of Di one wey oda users dey read well well
You fit see as voters take vote if you click hia: Link
Bola Tinubu wey be di national leader of di All Progressives Congress, say di party dey sure say dem go win di govnorship election for Lagos State.
Di former govnor of di state wey follow tori pipo yan afta e vote of Saturday, say "Lagos no be Kwara na," as im ansa kweshun onto di 'Otoge' movement wey shake Kwara State for presidential and national assembly elections.
"Na we be di only party for Lagos, di rest na repeater station. Dem dey come out evri four years and go back like crabs.
"Di state belong to di progressives, we be progressives and we go win dis election," im tok.
March 9Lagos govnor Akinwumi Amobode win for im unit on Saturday during di Govnorship and State House of Assembly vote.

16:25pm (Updates) Ambode party wey be APC wear PDP shirt for Ogunmodede Polling Unit 003, Ajaganabe Ward 5, inside Epe LGA
RESULTS:
House of Assembly: PDP: 61 APC: 253
Govnorship PDP: 62 APC: 262
For Lagos state wey dey southwest of di kontri, dis na di candidates wey dey conest for be govnor and dia deputies:

Wia dis foto come from, Inec

Wia dis foto come from, Inec

Wia dis foto come from, Inec

Wia dis foto come from, Inec

Wia dis foto come from, Inec

Wia dis foto come from, Inec

Wia dis foto come from, Inec

Wia dis foto come from, Inec

Wia dis foto come from, Inec

Wia dis foto come from, Inec

Wia dis foto come from, Inec

Wia dis foto come from, Inec

Wia dis foto come from, Inec











