Nigeria 2019 Governorship Elections: Why Akwa-Ibom, Rivers, Cross Rivers and Kano na states to watch

29 states go do gubernatorial elections on Saturday 9 March to decide who go be dia govnor for anoda four years.
Inside some states, court order don spoil di plans wey some big political party dem get to contest di elections on Saturday.
Dis na some of di states dem where di election go dey very interesting.
Cross River
APC no get govnorship candidate for Cross River.
Dr Frankland Briyai wey be di resident electoral commissioner for di state tell tori pipo dis one for Central Bank of Nigeria office as dem dey inspect di sensitive materials dem go use for di govnorship and
state house assembly election.
Oga Briyai say 25 candidates go contest for di govnorship election and for APC dia logo go dey ballot but dem no get candidate.
Cross Rivers State get over 1.5million registered voters for di state and since 1999 na people's Democratic Party don win all di govnorship election.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di current govnor Prof Ben Ayade of PDP dey run for im second term for office.
Akwa Ibom
Akwa Ibom State for south-south Nigeria na one of di states wey di kontri ruling All Progressives Congress (APC) dey hope to add to places wey dem don win.
Di kontri main opposition party, Peoples Democratic Party, candidate and current governor Udom Emmanuel dey seek second term rule for di state and im dey come up against over 37 oda candidates.
One of dem na Nsima Ekere wey be di candidate of di APC and main challenger for the position.
Senator Godswill Akpabio wey decamp from PDP to APC for August 2018 go wan use dis election show im strength.
During di presidential elections PDP win di state with 395,832 votes to APC 175,429 and dis na one if di reasons why e go dey interesting to see if dem go still hold onto di state with another win for Udom Emmanuel.
Kano
Di reason why many pipo dey expect Kano governorship elections for north-western Nigeria to be one of di toughest be say di struggle na between two men wey strong well well.
Former Kano Governor Rabiu Kwankwaso founder of Kwankwasiya get loyal supporters wey ready to do anything for am while Governor Abdullahi Ganduje wey don do four years in power don use di
opportunity comot from Kwankwaso (im former boss) shadow form im own loyal followers wey dem dey call Gandujiyya.
So in essence pipo dey wait to see who go come out on top between Kwankwasiya and Gandujiyya members.
For Kwankwaso wey be like Nigeria main opposition PDP leader inside Kano, di stakes dey higher because e no dey go back Senate so if im in-law wey hold di Peoples Democratic Party ticket to be Governor,
Abba Yusuf no win, e fit affect Kwankwaso political career.

Rivers
For Rivers State, di main challenger against di current guvnor, Nyesom Wike of PDP na di All Progressives Congress, APC. But as e come bi so, APC no go contest election for Saturday sake of say court don rule say dem no do dia party primaries well.
APC just adopt di AAC candidate, Biokpomabo Awara yesterday and some pipo bin dey wonder if dis one fit helep dem for di election.
Apart from PDP and APC, anoda candidate wey pipo dey tok about for Rivers State na Dumo Lulu Briggs of Accord Party but a Federal High Court judgement don knack am comot from di race.
Wetin make Rivers State more interesting na say Chibuike Amaechi wey be former govnor for Rivers State and President Muhammadu Buhari chief campaigner wan take full control of di state.
Some oda candidates dem like Labour Party man, Isaac Wonwu; Action Democratic Party ADP, Victor Fingesi, still dey for Rivers.














