Koffi Olomide don chop 2-year suspended prison sentence for sexual assault on 15-year-old dancer

Wia dis foto come from, Getty Images
One French court don nack Congo music star Koffi Olomide two year suspended prison sentence for sexual assault ontop one 15-year-old girl, wey be one of im dancers.
Di musician popularly known for im Soukous music face accuse say im sexually assault four of im dancers.
Prosecutors for di trial for Nanterre, near Paris last month call for seven-year sentence against Koffi and suspended sentences for two of im former employees wey detain di dancers.
Di 62-year-old, wey im real name na Antoine Agbepa Mumba, bin get order from court to pay $5,700 (£4,300) in damages to im former dancer, and ontop anoda $5,700 fine sake of say im help three of di women enter France illegally.
Di dancers say three men detain dem while Koffi been dey on tour for France between 2002 and 2006 and dem also withhold dia passport.
Dem say Koffi force dem to sleep with am and im beat dem if dem no agree.
Tori be say di four dancers manage to escape from di villa for June 2006 and dem no return to Democratic Republic of Congo since for fear of reprisal.
Olomide been deny di assault charge as well as allegations say im help di dancers enter France illegally.
End of Di one wey oda users dey read well well
Palava wey Olomide don enta before
For 2018 Zambia order im arrest afta e allegedly assault one photographer
For 2016 dem arrest and deport am afta he assault one of im dancers for Kenya
For 2012 dem convict am DR Congo sake of say im assault im producer and e collect three-month suspended prison sentence
For 2008 Im get accuse say im kick one cameraman from DR Congo private RTGA television station and break di man camera for one concert for Kinshasa but dem settle di mata later later











