You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ethiopian Airlines crash: Dem don confam say 157 pipo don die
Evribodi wey dey di Ethiopian Airlines plane wey crash afta e take-off on Sunday don die, di airline tok.
Dem say na 149 passengers and eight crew members wey dey flight ET302 from Addis Ababa to Nairobi for Kenya.
Di airline add say na 33 different kontri pipo dey on board di plane.
Spokesman talk say di crash happen around 08.44 local time on Sunday, shortly after dem take-off from di Ethiopian capital.
Prime Minister Abiy Ahmed tweet en "deepest condolences to di families of those wey lose dema loved ones".
Ethiopian Airlines put di sad news for dema official website top, dem also explain say dem dey establish passenger information center den telephone number which dem go make available soon to family den friends get people for di flight top.
Tori be say Ethiopian Airline don ask families of passengers to gada for di Four Points by Sheraton Hotel near Jomo Kenyatta International Airport.