Lydia Alhassan: Ghanaians blast NDC MPs over ‘Bloody widow’ tag

Wia dis foto come from, Office of the President/Ghana
Ghanaians for social media bore say minority members for Parliament today describe di newly elected Member of Parliament for Ayawaso West Wuogon, Lydia Alhassan as "bloody widow."
Lydia Alhassan be di second wife of late New Patriotic Party (NPP) MP, Emmanuel Boakye Agyarko who die after short illness.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 1
Pipo make shocked say lawmakers go fit say something like dis wey dey insult di woman plus en unfortunate situation.
While dem wan swear in di new MP for Parliament, di minority members stage walk out wey some of dem carry placards wey dem write "bloody widow" for top dey take describe di woman.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 2
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 3
First Deputy Speaker of Parliament, Joseph Osei-Owusu swear am in despite di minority boycott.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 4
Sarah Adwoa Safo who be Deputy Majority Leader talk say despite di disappointing posture of di NDC minority, Lydia Alhassan be competent, she get courage, en heart be good, we know en past records say she dey work hard.
Meanwhile minority members for Ghana Parliament dawg di swearing in ceremony of newly elected New Patriotic Party (NPP) lawmaker, Lydia Alhassan after she win last week by-elections.
As dem dey leave di chamber, dem hoot at di Speaker of Parliament wey some hold up placards which dem write 'bloody widow' for top.
End of Di one wey oda users dey read well well
But one majority MP, Sara Adwoa Safo talk di minority say dema posture be disappointing den bad.
Di minority MPs after dema boycott, march go Police Headquarters for Ghana where dem petition Inspector General of Police, David Asante-Apeatu say make he ensure say dem go arrest den prosecute di rogue forces wey beat beat people during di Ayawaso West Wuogon by-election.
Minority MP, Rockson Dafeamekpor talk BBC Pidgin say "di police fail to take di complain statement of wanna colleague MP wey di security people attack. We dey demand say make dem punish di perpetrators."
According to di Minority, days after di violent attacks Ghana Police still no arrest any of di security operatives.
Dem talk police say dem see some of di culprits wey dem go like help police identify den deal plus dem.
Most Ghanaians bore say di security forces use enraged extreme force on civilians as elections dey happen.
Ghana President Akufo-Addo, condemned di acts of violence wey he promise say police go investigate di matter."
Di masked security operatives last week, open fire for some opposition activists top wey dem injure like 18 people.













