Atiku Abubakar: Why PDP Presidential candidate visit to America shake Nigeria

Wia dis foto come from, Osita Chidoka
Former Nigeria vice president Atiku Abubakar travel go Washington DC on Thursday for di first time since 13 years and make plenti tori dey waka upandan about why im no enta di kontri for dat long.
Di koko wey make Atiku no visit US since na sake of say e get one American Senate report wey show im name among oda pipo wey get corruption case to answer for US say im do moni laundering and im collect bribe from phone company Siemens.

Wia dis foto come from, ATIKU/TWITTER
Atiku visit to America to do tok-tok wit some American officials about im 2019 Political campaign inside Nigeria fit be say na former Nigeria president Olusegun Obasanjo and oda lobbyists arrange di visit, according to News Agency of Nigeria
According to News Agency of Nigeria di 2005 report against Atiku also chook eye into report wey say Atiku and im fourth wife Jennifer Douglas break US laws.
One tori say e get wen im apply for US visa but dem no gree give am.

Wia dis foto come from, ATIKU/TWITTER







