Justice Onnoghen: Top-top lawyers dey prepare to defend di CJN ontop im case wit CCB

Wia dis foto come from, National Judicial Council
Former president of di Nigerian Bar Association and Senior Advocate of Nigeria Olisa Agbakoba say di process wey dem take bring case come di Chief Justice of Nigeria Walter Onnoghen domot no pure.
Dis one na afta di Code of Conduct Tribunal (CCT) for Nigeria schedule Monday, January 14 as di day to start di trial against Justice Onnoghen ontop accuse of non asset declaration wey di kontri Code of Conduct Bureau file against am.
Since di tori break, pipo don dey react to di mata and some say e no pure at all.
Agbagkoba tell BBC say di normal process na for di National Judicial Council (NJC), wey all Justice dem belong to torchlight di mata if di Attorney General of di kontri carri any mata come.
According to Agbakoba, Justice Onnoghen get immunity and di case no fit go far.

Wia dis foto come from, OAL.LAW
"Dis anyhow behaviour need to stop... because if dem try push di case forward, di gbege wey go happun for di judiciary system of dis kontri go be like one wey nobody don see before.
I mysef, dey carri dis [Onnoghen] case mata go court to prove say e dey illegal," Na so Agbakoba tok.
Agbakoba say na only two ways constitution allow for Chief Justice to chop sack. One na when lawmakers bring mata against am for senate, and two thirds of dem vote to comot am. Di oda na when NJC demsef comot am.
End of Di one wey oda users dey read well well
Nigeria Bar Association reaction
According to di current president of di Nigeria Bar Association Paul Usoro, di case na one of "consistent assault by agencies of di federal goment of Nigeria against di legislature and judiciary.
Inside statement wey BBC Pidgin take eye see , Usoro tok say di same tin wey dem do Senate president Bukola Saraki na in dem dey do to CJN now too.
"Make dem no create di impression say di agencies of di executive arm of federal goment get di mind to destabilize and useless di oda arms of goment and also destroying checks and balances," na so so Usoro tok.
Im also call on goment to follow due process.

Wia dis foto come from, SARAKI TWITTER
'I bin forget'
Justice Onnoghen don explain wetin happun ontop di non declaration of asset mata, according to tori pipo News Agency of Nigeria, e reply CCB say di mata no be like dem dey see am.
"My asset declaration form numbers SCN 00014 and SCN 00005 come on di same day, 14/12/2016 because I bin forget to do anoda declaration of my assets after my 2005 declaration expire for 2009". Na so Onnoghen tok.
News Agency of Nigeria (NAN) bin report say na di Anti-Corruption and Research Based Data Initiative (ARDI) file di petition against Justice Onnoghen.













