Benue killings: One year afta suspected herdsmen kill 73 pipo goment say tins don change for di state

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI
Benue goment for North Central Nigeria say since Army start operation cat race for di state, tins don change and di herdsmen don stop to dey invade and attack innocent pipo for Benue anyhow.
Tok-tok pesin for Benue state goment Terve Akase tell BBC Pidgin dis one as di state and di state chapter of di Christian Association of Nigeria organise memorial service to remember di over 73 victims of di herdsmen attack of January 1 last year.
Di Service to remember di victims of di herdsmen attack happun for di state capital Markudi for Our Lady of Perpetual Help Cathedral.
Terve tok say di reason why dem organise di memorial na to tell di victims dem say even though dem don die say Benue pipo no go ever forget dem.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di January 1 2018 attack by di suspected herdsmen happun afta di state goment bring out new anti-grazing law.
Di communities wey di fight affect na Gaambe -Tiev, Ayilamo, Turan, Umenger, Tse-Akor and Tomaater near Tse -Abi for Logo and Guma Local Government Areas.
Pipo for social media chook mouth inside di mata.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3
Oga Terve say tins don change, calm down since di killings of 2018 afta Army start dia operation for di state.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na last year Army launch operation 'Cat Race' for Benue to end di herdsmen/farmers clashes and attacks on innocent pipo for communities dem for di state.
"Wit di new anti grazing law wey dey ground now for di state many herders wey break di law dem don arrest dem and collect dia livestock, some of dem pay fine before dem release dia livestock to dem dis na some of di progress wey don happun" na wetin Terve tok.