Benue: Herdsmen don kill 226 pipo between January and April - Goment

Benue State

Wia dis foto come from, Terver Akase

    • Author, Daniel Semeniworima
    • Role, BBC Pidgin, Lagos

For February dis year, Nigerian Army flag off Operation Cat Race (Ayem Akpatuma) for Benue State, to take stop all di killi-killi wey dey happen as herdsmen and communities dey clash for some middle belt states of di kontri.

Most pipo for Benue State, and Nigeria feel say as military start di operation and as President Buhari order say make more security go di area, say di killi-killi go stop.

But e be like say noting don change, as communities for di state still dey suffer attack and bury more pipo.

Di one wey dey pipo mouth now na di 24 April own wen suspected Fulani herdsmen kill two catholic priests and 17 worshippers for Ayar-Mbalom community for Gwer East Local Government Area.

According to wetin BBC News Pidgin don find, na at least 226 pipo don die inside kill kill for Benue State, between January and April dis 2018.

Figures wey we gada from di Benue State goment, show say na Guma and Logo towns na im get di highest number of pipo wey die.

January, 2018

Benue State

Wia dis foto come from, Terver Akase

February, 2018

Benue State

Wia dis foto come from, Terver Akase

March, 2018

Benue State

Wia dis foto come from, Terver Akase

April, 2018

Dis information come from di office of di press secretary to Benue State Governor Terve Akase, and security.