Dino Melaye: Police don carry di senator comot police clinic go anoda location

Dino Melaye

Wia dis foto come from, Nigeria Police

Wetin we call dis foto, Dino Melaye

Police don carry di senator wey dey represent Kogi West Constituency for Nigeria, Dino Melaye, from dia clinic where e bin dey receive treatment go di Department of State Services, (DSS) hospital for Abuja.

Police dey accuse di senator say e get hand inside di shooting of one of dia officer Sgt Danjuma Saliu wen im dey duty post for Kogi state for July 2018.

One of Dino family members confam give BBC Hausa say dem move di senator from police clinic go DSS facility, although e no gree make dem admit am for di hospital.

Im bin don surrender imsef for arrest last week Friday January 4 afta police lay siege, tanda im domot for one week ontop di mata

Dem carry Dino go Police Hospital for Garki, Abuja afta im suffer asthma attack.

Police bin wan shaperly carry Dino go face trial but im bin dey insist say e never dey strong to go.

Tori pipo Channels dey report say police confam give dem say dem true-true move di senator go DSS medical facility for Abuja afta di senator and di police no gree see eye to eye ontop di mata of im fitness to face trial.

Dem also tok say police don collect warrant from Federal Capital Territory (FCT) High Court to keep Senator Melaye for 14 days starting from Wednesday, January 9.