2019 UTME: See di JAMB approved CBT centres dem wey near your domot

Di Joint Admissions Matriculations Board (JAMB) don open di sales of forms for di 2019 examinations for Nigeria from Thursday, January, 10 till February 21, 2019.

JAMB na exam for candidates wey wan enta tertiary institution for Nigeria whether through Direct Entry (DE) or for di Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME).

Di join bodi wey dey organise di JAMB exam change tins dis year, cancel cyber cafe registration where some applicants bin dey go before-before to register for di exam.

JAMB announce dia decision last year say many of di business centre dem dey do magomago, make mistakes join and dis dey make am hard for students to get admission.

Di examination joinbodi say dem go still work wit some business centre or cyber cafe but any cyber cafe wey wan participate to register dia candidates for 2019 exam must first register wit dem.

Instead, all di candidates go nid to go wetin dem call Computer Based Test (CBT) centre wey dey around dem to register for di exam.

Tok-tok pesin for JAMB, Dr Fabian Benjamin, tell BBC Pidgin say di reason why dem no dey allow applicant to go fill form for house na because of di magomago wey some pipo dey do.

"You know some pipo, dem go just put dia own foto, come put dia pikin name, and den go write exam for dia pikin... so we don stop passport foto. Now we dey do live foto capture," Na so Dr Benjamin tok.

Live capture mean say applicant wey wan register for JAMB need to carri dia leg waka go CBT centre and na dia dem go use computer snap di student foto, take dia fingerprint and register dia informate, like choice of school.

Check approved CBT centres wey dey your state