You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Lionheart: Genevive Nnaji don dey collect accolades
Read am in 1 mins
Lionheart wey be Africa first original feem wey Netflix produce don land.
Di feem wey be di first movie Nigeria actress Genevieve Nnaji dey direct, and act, don already dey get accolades for social media on top di release.
Lionheart follow one woman wey take ova compnay gbese afta her papa die with her uncle.
Dem premier di feem for di Toronto International Film Festival for Canada in September.
Social media dey jolly di feem sotay Pete Edochie and Nkem Owoh, two actors wey don tey for di Nigeria movie industry and dey for di movie dey trend.