Parliamentary System of Government: Why 71 lawmakers dey ginger for Nigeria to shun presidential system of goment

Speaker Yakubu Dogara

Wia dis foto come from, House of Representatives

Wetin we call dis foto, Speaker Yakubu Dogara

'Nigeria need new political structure,' na im one lawmaker wey follow write one bill to return Nigeria back to parliamentary system of goment tell BBC News Pidgin on Friday.

Kingsley Chinda (PDP, Rivers) say di way wey di federal goment get plenti power no good and as e dey now, di kontri needs system of goment wey dem fit manage.

Dis bill wey 22 lawmakers join-bodi present pass first reading on Thursday for House of Representatives - wey be di lower chamber of di kontri National Assembly, local media dey report.

"We need to adopt a more manageable and realistic system. Di way federal goment di abuse dia powers show clearly say we neva ready and matured enough to manage the magnitude of powers the Constitution confers on the President" im explain for text message.

Ho. Chindah explain give say di only tin wey dey constant for life na change and di kontri no go continue to do the same tin and want beta result.

House of Representatives

Wia dis foto come from, House of Representatives

Parliamentary system of goment na di one wey lawmakers go elect among demsef who go be head of goment alias Prime Minister, inside dat arrange no be di pipo go elect di leader of di kontri as be di practice now for Nigeria where di pipo dey elect President wey be head of goment for presidential system of goment.

Di 22 lawmakers wey join-bodi present dis bill say dem don already increase to 71 pipo wey dey support di bill. Dem say dem dey collect more names of lawmakers wey go sign and support dia move, sand say dem sure say dem go get di two-out of-three majority wey dem need to change di law wey go see Nigeria return to parliamentary system of government.

Nigeria House of Representatives

Wia dis foto come from, @HouseNGR

Wetin we call dis foto, Nigeria House of Representatives

Tori be say di group of lawmakers wey belong to different politic party tell tori pipo say di presidential system of goment don become too expensive and e no dey give Nigerians di best type of leadership.

Hon. Nicholas Osai (Delta, PDP), wey present dia case to House of Representatives tori pipo say di aim na to bring about beta collabo for goment unto executive and legislature parol, according to THISDAY Newspaper report.

Wetin we call dis Video, Sergius Ose Ogun tell BBC pidgin why im sponsor di International Studies (Regulation) Bill