#Budget2019: Nigeria 2019 spend moni plan don ready

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency/Twitter
Nigeria goment on Friday put final approve unto di 2019 spend moni plan alias federal goment budget for lawmakers to consider.
President Muhammadu Buhari bin chair special federal executive council meeting earlier for Aso-Rock Abuja wia di presido and im ministers press hand give di spend moni plan wey di executive wan give di National Assembly.
Minister of Ministry of Budget and National Planning Udo Udoma tell tori pipo afta di meeting say: "Di 2019 Budget don ready."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
BBC News Pidgin eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.







