"Father Mbaka 'you go fail' video to Peter Obi surprise us" - Catholic Church

Reverend Father Ejike Mbaka

Wia dis foto come from, Adoration Ministry Enugu

Wetin we call dis foto, Reverend Father Ejike Mbaka
Read am in 2 mins

Reverend Father Ralph Madu, di secretary general of di Catholic Bishop's Conference of Nigeria, say dem surprise on top video wey show Reverend Father Ejike Mbaka nack prophesy say di opposition PDP ticket of Alhaji Atiku Abubakar/Peter Obi go fail.

Reverend Madu tell BBC Pidgin say na for Kano state, north central Nigeria wia Bishops dey celebrate 100 years of di Catholic Church for Nigeria, dem watch di video wey dey spread for social media.

Reverend Madu say: ''Wen we return to our base we go torchlight di mata to know weda di Bishop for Enugu know wetin dey happun for im Diocese''.

''No national sanction go dey, e rest for di hand of di oga of Diocese to handle di mata,'' na so Rev. Fr. Madu tok.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Wetin Rev. Fr. Mbaka tok for di viral social media video?

Pipo for social media para scata for early dis week wen video of Rev. Fr. Mbaka during one harvest for Sunday in Enugu, south east Nigeria show as im dey ginger Peter Obi to donate moni to di church, complete wit warning say God hate pipo wey stingy.

Oga Obi bin try tell Father Mbaka wey be di spiritual director of di Adoration Ministry, say wen dem dey private corner, im go tell am wetin im wan drop.

Peter Obi

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Peter Obi, PDP vice-presidential candidate for 2019 election

But Mbaka, wey dey use Igbo and English tok, provoke say na wayo for Obi, di former Anambra state govnor to come im church and no drop any moni.

Mbaka come draw ear warn di Atiku campaign say dem fit no progress if Alhaji no show for Enugu to sidon do meeting wit am.

Meanwhile Peter Obi don beg pipo make dem stop to dey attack Mbaka unto wetin im tok for Sunday.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Obi tok tok pesin Val Obienyem, say make pipo no abuse Fr. Mbaka.

Obi say, ''while pesin fit no gree wit di catholic priest, make we remember say wetin im dey tok and do na from higher wisdom level''.

Obi still tok say e dey wrong to attack priests based on wetin dem tok for altar and im encourage pipo mak dem remember to dey pray for priests.