Dance video: 'Pipo dey ask me funny kwesion because I be man wey dey dance wit heels'
- Author, Princess Igho Williams
- Role, Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
Nigerian dancer, Ude Bright Michael Ifeanyi wey don dey dance for 11 years say no be small kwesion pipo dey ask am on top im decision to begin dance wit high heels.
Mr Ude Bright wey study Economics from Abia State University, tell BBC NewsPidgin say im begin dance wit high heels two weeks ago because e wan dey different from everi oda pesin or dancers.

"Pipo dey ask me funny questions like weda I be gay or weda na dis kind life I wan to dey live as dem see me dey dance wit heels."
"Some dey wonder which kind man go dey wear heels dey dance wey pesin wey be woman neva even fit dance wit heels like dat.
"But I let dem understand say to dance wit heel no change anytin or pesin personality."

Pipo like Yanis Marshall, Kazaky guys and oda great dancers dey among wetin ginger Ude Bright to begin use high heels to dance.
"Back in di days I don dey watch some kain video of Madonna and Beyoncé wey men dey dance on heels and dem dey call dem kazaky guys."
"See those guys dem be perfectionist, dem dey dance like say no tomorrow and di heels wey dem dey wear pass di one wey me dey wear."
End of Di one wey oda users dey read well well
"So I dey look up to those guys and Yanis Marshall because di way dem dey dance e dey different from evri oda pesin."

Mr Ude Bright say for Nigeria pipo dey discriminate guys wey dey dance on heels and dis don make some of dem dey hide demsef, dem no wan come out.
" I just want make we stop dis discrimination for dis guys so dem go dey free to dance for di love of dance."
E add say di kain message e wan pass through dancing na say:
"No mata wetin any pesin dey go through, wit dance dem fit pour am out and wen dem dey dance dey fit forget all dia sorry."

Base on di history of High heels, na men bin dey wear am originally before in those days.

Wia dis foto come from, Getty Images
Elizabeth Semmelhack from di Bata Shoe Museum inside Toronto tok say: "Di high heel dem dey wear am for centuries throughout di near east (part of di world) as form of riding footwear"
"Wen soldier stand up for im stirrups (dat na wetin dey hold di legs of pesin wey dey ride horse), di heel dey help am to secure im balance so dat e go fit shoot im bow and arrow wella"












